# The HarmonyNaijaDAO Meetup 2.0!

**URL:** <https://talk.harmony.one/t/the-harmonynaijadao-meetup-2-0/14597>\
**Category:** Naija DAO\
**Created:** [March 22, 2022, 7:15pm UTC](https://talk.harmony.one/t/the-harmonynaijadao-meetup-2-0/14597 "2022-03-22T19:15:23Z")\
**Posts on this page:** 2\
**Page:** 1

<div class="post-metadata">

**Author:** ![Nwaobi\_Daniel](https://yyz1.discourse-cdn.com/flex035/user_avatar/talk.harmony.one/nwaobi_daniel/32/13962_2.png) [@Nwaobi\_Daniel](https://talk.harmony.one/u/Nwaobi_Daniel)\
**Post date:** [March 22, 2022, 7:15pm UTC](https://talk.harmony.one/t/the-harmonynaijadao-meetup-2-0/14597/1 "2022-03-22T19:15:23Z")

</div>

My people how una dey?  
Naija Harmonauts una dey so?!

Una sabi say we don do first meet up for Benin wey we meet other NaijaHarmonauts wey dey around that region.  
Una see the pictures and video na…see as e go abi?  
You fit view am [(here)](https://drive.google.com/drive/folders/18QDY_UywPcUfIT7j6DRcji2WnhV8TLUT?usp=sharing), [(here)](https://drive.google.com/drive/folders/1vvUbLPCaAWVeUOiW-a19Pg1dbyFCea61?usp=sharing) and [(video for here)](https://drive.google.com/file/d/1LcZlcFM4Neo1ZoQmhTRsRoD4lrNgLbRp/view?usp=sharing) incase you miss the gist

The ghen ghen gist now be say we dey carry the 2nd meet up come Lagos!  
We go like bring the Harmony Gospel reach Lagos make people sabi all wetin Harmony Protocol dey about.

**The HarmonyNaijaDAO 2nd Meet up** na for Unilag Campus e go happen.  
**Date na 2nd of April, 2022.**  
**Turn up time na 11am!**

 ![Harmony Naija Meetup 2.0 (1)](https://canada1.discourse-cdn.com/flex035/uploads/harmony1/original/2X/1/1274516f986c9b3e50922982e7b4358b89a9a8bf.jpeg)

If your friend na blockchain enthusiast, you suppose carry am join body as you dey come that day o…come network with fellow NaijaHarmonauts wey dey speak the same blockchain language wey you dey speak.

Tori go fall out for our [Telegram](https://t.me/harmonynaijadao), so put eye for there o make this beta no pass you

---

<div class="post-metadata">

**Author:** ![Ebuka\_Arinze](https://yyz1.discourse-cdn.com/flex035/user_avatar/talk.harmony.one/ebuka_arinze/32/6637_2.png) [@Ebuka\_Arinze](https://talk.harmony.one/u/Ebuka_Arinze)\
**Post date:** [March 22, 2022, 7:16pm UTC](https://talk.harmony.one/t/the-harmonynaijadao-meetup-2-0/14597/2 "2022-03-22T19:16:26Z")

</div>

This would be amazing.

I would be there for sure.
